National Politics

Bayelsa, Kogi election result: Buhari tell Nigeria to accept defeat wit grace

President Muhammadu Buhari recieve Governor-Elect of Bayelsa State, David Lyon for State House on Monday.

Bayelsa – President Muhammadu Buhari receive Governor-Elect of Bayelsa State, David Lyon for Aso Rock Abuja on Monday where im go present im sef as di tear-rubber Govnor from Nigeria ruling APC party.

Afta Nigeria election office – Independent National Electoral Commission – Inec declare Yahaya Bello winner of di Kogi State govnorship elections, opposition Peoples Democratic Party – PDP don reject both di Kogi and Bayelsa results.

But President Buhari wey don sama congratulobia give all di winners wey be members of im party also tell di main opposition PDP to accept defeat wit grace.

Di All Progressives Congress (APC) win di November 16 Governorship elections inside Kogi and Bayelsa States, increasing di number of states wey dem dey control to 19 of the 36 states across di kontri.

For di February general election, wey President Buahri take win second term, im party lose five govenorship seats, according to statement from Buhari tok-tok pesin Garba Shehu on Monday.

Di time wen APC lose nobodi complain and di Buhari goment bin accept di results, so make PDP no cry say dem be victim dey attack di election office – Inec, Oga Shehu add.

“Congratulations to Govnor Yahaya Bello on im re-election. Na race well run and victory well won. I wan encourage am to use dis second term as opportunity to build on di foundations im don already lay down to improve lives of di pipo of Kogi State,” Buhari bin write ontop Twitter.

Yahaya Bello and Muhammadu Buhari dey shake hands

Meanwhile, di main opposition party Peoples Democratic Party and dia candidate Musa Wada, don reject di “outcome” of di election.

READ ALSO – Mahmood Ahmadu’s Innovate 1 Pay Features On The Front Cover Of The Financial Times

Dem say no election happun on Saturday 16 November 2019 but instead na “war against di people” take place.

Inside statement wey PDP release on Monday, dem accuse APC say dem carry police helicopters begin attack pipo wey come out to vote, and say dem use “thugs to shoot and kill voters, snatch ballot box”.Skip Twitter post by @OfficialPDPNig

Official PDP Nigeria@OfficialPDPNig

#KogiDecides2019: Full Text of Press Conference by the @OfficialPDPNig Gubernatorial Candidate in Kogi State, @_musawada on the outcome of the election. The text is titled: The Position of the @OfficialPDPNig on the Conduct and Outcome of the Election. Read below

View image on Twitter
View image on Twitter

1371:40 PM – Nov 18, 2019Twitter Ads info and privacy49 people are talking about this

End of Twitter post by @OfficialPDPNig

Even though Buhari say im sorry for di violence wey thugs cause during di election, di president say na “di work of di political sponsors wey send dem” di thugs bin dey do.

Source – https://www.bbc.com/pidgin/